adsense

Saturday, August 20, 2016

60 year old man rapes eight year old girl in Sapele, Delta State


According to a report shared on 'Facebook by Sapele OgheneK, the incident occurred a Christmas road. The mother, a petty trader noticed her daughter was sick and acting very weak so she decided to take her to the hospital.

On arrival at the hospital, the doctor confirmed that she has been molested. After several beating, she confessed that it was a welder who lived near their house that tampered with her. Read full story with pidgin english after the page break.

Yesterday here for Christmas Road by Akpojotor lane nai another evil for happen here for Sapele. One small Girl pikin wey her mother dey leave under penury,due to say na petty trade she dey do. The Pikin name na Favour. Her mother dey sell breaking groundnut. The mother cum observe say,her Daughter be like who dey sick,as she dey weak. Nai dem rush her go Sapele Central Hospital,where the Medical Doctor for confirm say them temper with the child private part. 

Na after them beat the pikin,she cum talk say na one Welder wey dey stay near deir compound wey dem dey call Ogwefi nai sexually assault her. The poor woman cum demand for mare drugs to treat the female child,due to wetin she fit afford. 
Na when she reach House confront the man,nai the area people cum know wetin dey happen. 
As at yesterday wey some group of touching mothers wey dey Oyibo country contact me,nai dem throway phone calls give Civilian DPO,Mr Victor Asikolo to go arrest this Mr Ogwefi a.k.a Okrimini to main Station. As we talk now,the man dey Police custody.

We cum throway our eyes enter the man life,to find out say,he wife and children don run leave am long time ago,due to say na drunkard and e nor dey fit meet up,with him family responsibilities, to the extent say na one Pool office e dey sleep through the night.
Tears just dey flow from my eyes becos,this issue don dey dey too rampant within Sapele and e dey cause serious health damage to the little children and e dey leave dem with Life trauma.
This morning I dey bring up this issue becos we get two factions from the area people,as one set say make dem pardon the man due to him current predicament, why the other say make Law takes it fullest charge.
Na we be the voice of the masses and the poor and na wetin we decide here we go use look into this case.


First I dey use this update dey call on our Lawyers,to visit this issue with all seriousness to get to the root of this issue and persecute the offender.

As at when we send our team to visit the child parents,we cum see the mother dey boil her groundnuts wey she wan go sell and we also snap the small Girl for we all to see and imagine wetin 60years old man wan enjoy for this pikin body. We promise to get the man pictures despite say him don reach Police hand.
We stand against those wey dey oppress the poor for Sapele and Delta State and also we nor go condole any act wey go cause more problems for us,to dey draw the town back the more.

This child need good medications and finance to enable the family stand the challenges,as well as Lawyer. Show ur Love to the family and obtain 

No comments: